Senegal move to di top of dia group for di African qualifiers for di 2026 World Cup na Habib Diallo header give di Teranga Lions 1-0 win for Mauritania.
Di striker bin get in front of im marker on di edge of di six-yard box to connect wit cross from Tottenham midfielder Pape Matar Sarr for di 27th minute for Nouakchott.
Long delay bin dey bifor dem complete di match afta frustrated home fans throw objects for di pitch for di second half na sake of dat dem pause di game.
DR Congo dey one point behind Senegal for Group B table afta di Leopards win 1-0 for dia house against Togo, na Brentford forward Yoane Wissa pass set up Meschack Elia to score di only goal of di match.
Meanwhile, Tunisia perfect start end wit goalless draw away against Namibia, but di Carthage Eagles still dey top of Group H on 10 points.
Skip Recommended articles and continue reading
Recommended articles
How to watch all Afcon games and facts wey you suppose sabi
Nigeria, Ghana, Morocco, kontris 2026 World Cup qualifiers squad list
Nigeria struggle wit Lesotho for dia first 2026 world cup qualifying match
'We dey go war as teammates and brothers' - Victor Osimhen declare as Nigeria jam Cameroon for round of 16
End of Recommended articles
All nine group winners at di end of di 10-match campaign go qualify for di 2026 finals, while anoda African side fit book dia spot for di United States, Mexico and Canada through di intercontinental tournament.
See how di African group table Fifa world cup qualifiers.
African World Cup Qualifying table
Group A
Group B
Group C
- E do well as player, e go do well as coach? – Finidi George first test as Super Eagles coach
- Euro 2024 full squad list of national teams
- Rangers vs Enyimba Oriental derby, ogbonge NPFL game end in rofor-rofor – wetin happun?
Group D
Group E
Group F
Group G
Group H
Group I
CAF World Cup Qualifiers fixtures
Di first two matches for each group dem play am between 15 and 21 November, while rounds three and four dey take place dis June.
Di remaining six match days of World Cup qualifiers dem go spread am across di international windows for March, September and October 2025.
Sunday 9th June
Group A
- Djibouti vs Ethiopia 5pm WAT
Group B
- Congo DR vs Togo 5pm WAT
- Mauritania vs Senegal 5pm WAT
Group H
- Sao Tome e Principe vs Liberia 2pm WAT
- Namibia vs Tunisia 5pm WAT
Monday 10th June
Group A
- Burkina Faso vs Sierra Leone 5pm WAT
- Guinea-Bissau vs Egypt 5pm WAT
Group C
- Benin vs Nigeria 5pm WAT
Group E
- Eritrea vs Niger (C)
Group G
- Somalia vs Botswana 2pm WAT
- Uganda vs Algeria 5pm WAT
- Guinea vs Mozambique 8pm WAT
Group H
- Equatorial Guinea vs Malawi 2pm WAT
Group I
- Madagascar vs Mali 2pm WAT
- Ghana vs Central African Republic 8pm WAT
Tuesday 11th June
Group B
- South Sudan vs Sudan 2pm WAT
Group C
- South Africa vs Zimbabwe 5pm WAT
- Lesotho vs Rwanda 5pm WAT
Group D
- Mauritius vs Eswatini 2pm WAT
- Cape Verde vs Libya 5pm WAT
- Angola vs Cameroon 8pm WAT
Group E
- Zambia vs Tanzania 2pm WAT
- Congo vs Morocco 5pm WAT
Group F
- Kenya vs Ivory Coast 2pm WAT
- Gabon vs Gambia 8pm WAT
- Seychelles vs Burundi 8pm WAT
Group I
- Chad vs Comoros 5pm WAT
Sunday African 2026 World Cup qualifying results
- Djibouti 1-1 Ethiopia (Group A)
- DR Congo 1-0 Togo (Group B)
- Mauritania 0-1 Senegal (Group B)
- Namibia 0-0 Tunisia (Group H)
- Sao Tome e Principe 0-1 Liberia (Group H)
How teams fit qualify for di 2026 World Cup?
Caf don cancel di traditional preliminary round wey dem bin dey use bifor.
Di new plan go see all African nations take part for a larger group stage - di 54 entrants dem split dem into nine pools, each group get six teams.
But, Caf plans spoil afta Eritrea late withdrawal from qualifying on 10 November, now Group E get only five teams.
All di kontris wey top dia qualifying group go automatically book dia place for United States, Mexico and Canada tournament.
While some of di (runners-up) dat one mean second position for table of di nine qualifying groups go get another chance to reach Canada, Mexico and USA.
Di four best-ranked second-placed sides go play for play-offs, wey go see dem play semi-final and final for November 2025 to determine which African side go advance to di intercontinental play-off tournament.
Eritrea withdrawal go affect dis rankings, Caf neva tok yet how dem go take solve dis matter.
Di final global qualifying round go involve six teams wey go compete for di final two places for di 2026 finals, and e dey expected to take place for March 2026.